Sowore Revolution Now: di man wey dey ginger protest across Nigeria

Sowore – Nigerians go wake on Monday, August 5, to know weda di protest against bad governance wey Omoyele Sowore dey ginger for, go hold after authorities arrest am last Saturday.

Secret spy police – Department of State Services (DSS) don tok say dem arrest Sowore “for threatening public safety, peaceful co-existence and social peace inside di kontri.”

Since wey dem arrest Sowore, na so many ogbonge Nigerians dey condemn di move, some don say di protest must go on, but who be dis man wey dey dinger Revolution Now across Nigeria?

  • Omoyele Sowore no be today meat, na since di days of June 12, 1993 na im e begin ginger for Nigeria mata.
    Him na son of Ilaje land for Ondo State, South West Nigeria.
    Born February 17, 1971, Sowore na human rights activist, pro-democracy reformer.
    Na him be di founder of tori pipo, Sahara Reporters wey e start for 2006 inside one small room for Manhattan, USA.
    He get Bachelor’s Degree (Geography and Regional Planning) University of Lagos from 1989 to 1995 (But e get two extra years sake of Aluta ginger).
    E become Student Union Goment (SUG) President, University of Lagos between 1992 and 1994 (E follow lead serious protest against military goment wey bin cancel June 12, 1993 Presidential election and fight against goment corruption).
    He also get Master’s Degree (Public Administration) from Colombia University.
    E become Presidential Candidate of di African Action Congress during di February 2019 Presidential election for Nigeria.

Read Also – Mahmood Ahmadu’s Innovate 1 Pay Features on the front cover of the Financial Times

Sowore (‘Showore’ as dem dey pronounce am) na Nigerian wey don spend di last 15 years to dey work to promote human rights and democracy inside Nigeria, and to stop di military rule and gbege wey foreign oil companies cause for im kontri.

For 1989, Sowore follow for student ‘I-no-go-gree’ waka to protest di conditions wey dey inside one International Monetary Fund (IMF) loan of $120 million goment bin wan use for one Nigerian oil pipeline construction – di IMF loan conditions na to reduce di number of universities in di kontri from 28 to just five.

Source – https://www.bbc.com